Nnam Ukwu!

No gree for anybody, no be when you meet person like Soludo o…
If you see person wey be like my Oga Soludo, abeg gree for am. Make yeye slogan no go make you start to dey argue with person wey you suppose dey listen to this year o!
Baba don come through for 5000 young people, give them Teaching job!
Baba don come through for 400 Health workers, give them work!
Baba don come through for another 5000 young people… him give them skills plus money to take start their hustle.
Baba don come through for pregnant women and their husbands… him give them free antenatal and free delivery, including Caesarian sessions.
Baba don come through for road matter… as I dey type him they run over 400km of roads across the State.
Baba don give Agbero run for town. No road for them again for the State.
Baba na correct guy, I go run una more update on top this matter.
— Mazi Ejimofor Opara.








